My pikin, make yu listin to wetin I dey tish yu
and nor ever forget wetin I sey make yu do.
Listin to wetin dey wise
and try make yu undastand am.
Yes, make yu beg for wisdom
and yu go get undastandin.
Find am well-well,
just as yu go take look for silva or oda good tins.
If yu do like dat, yu go know wetin e mean to fear God
and yu go susid as yu dey learn about God.