1
Proverbs 3:5-6
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Make yu always dey trust God with all yor heart, but nor trust wetin yu tink sey yu know. Always dey remember God kommand for anytin wey yu dey do, den E go show yu di korrect way.
Compare
Explore Proverbs 3:5-6
2
Proverbs 3:7
Nor tink sey yu wise pass di way yu bi, but just obey God and nor do bad tins.
Explore Proverbs 3:7
3
Proverbs 3:9-10
Honor God with yor money kon offa di first fruit wey yu harvest from yor farm gi-am. If yu do so, korn go full yor store and yu go get plenty wine to keep.
Explore Proverbs 3:9-10
4
Proverbs 3:3
So make yu always get faith and dey honbol; tie trut and mesi round yor neck kon rite dem for yor heart.
Explore Proverbs 3:3
5
Proverbs 3:11-12
My pikin, if God korrect yu, listin well and take am as warnin. Bikos God dey korrect only di pipol wey E love, just as papa dey korrect di pikin wey e dey proud of.
Explore Proverbs 3:11-12
6
Proverbs 3:1-2
My pikin, make yu nor forget wetin I tish yu and always remember wetin I sey make yu dey do. Wetin I tish yu go make yu prosper and get long life.
Explore Proverbs 3:1-2
7
Proverbs 3:13-15
Pesin wey wise and get undastandin, na happiness go bi en own. Undastandin get gain pass silva and e betta pass gold. Wisdom get value pass gold and e nor get anytin wey yu fit use take kompare am.
Explore Proverbs 3:13-15
8
Proverbs 3:27
Anytime wey yu fit, make yu do good to pipol wey nid am.
Explore Proverbs 3:27
9
Proverbs 3:19
God kreate di eart with en wisdom and na en undastandin E take make di heavens.
Explore Proverbs 3:19
Home
Bible
Plans
Videos