Proverbs 2:1-5
Proverbs 2:1-5 PCM
My pikin, make yu listin to wetin I dey tish yu and nor ever forget wetin I sey make yu do. Listin to wetin dey wise and try make yu undastand am. Yes, make yu beg for wisdom and yu go get undastandin. Find am well-well, just as yu go take look for silva or oda good tins. If yu do like dat, yu go know wetin e mean to fear God and yu go susid as yu dey learn about God.





