Solomon, David pikin wey bi king for Israel, na-im rite all dis wise word. E rite dem so dat pipol go get wisdom, undastandin and good advise.
Dis words go tish una how to live betta life,
to dey honest and to dey tok trut and korrect word.
Dis words fit make pesin wey nor know anytin get sense
and e go tish yong men how to work and get money.