Bikos of dis, God raiz am up
kon gi-am di name wey big pass evry oda name,
so dat wen dem koll Jesus name,
evribody and evritin must knee down,
weda dem dey heaven, eart or for under di eart
and evry tongue go konfess sey,
“Na Jesus Christ bi di Oga God.”
Den all di glory go bi God own.