1
Filippians 3:13-14
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
My brodas and sistas, I nor look mysef like sey I don get evritin wey I wont. Bikos I dey tink of only one tin wey bi: To forget di tins wey don pass kon dey porshu di ones wey dey front and as I put my mind for dis tins, I dey try to get di prize wey bi life for heaven; prize wey make God koll us thru en pikin, Jesus Christ.
Compare
Explore Filippians 3:13-14
2
Filippians 3:10-11
Wetin I wont na to know am and di pawa wey wake Christ from deat; to sofa wetin e sofa; to bi as e bi wen e die, so dat mi too go still wake-up from deat, as e wake.
Explore Filippians 3:10-11
3
Filippians 3:8
Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ
Explore Filippians 3:8
4
Filippians 3:7
But all dis tins wey I si as gain, I kon kount dem to bi nor-tin bikos of Christ.
Explore Filippians 3:7
Home
Bible
Plans
Videos