Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart. For anytin wey una dey do, weda una dey tok or do oda tins, make una do am with awa Oga God Jesus Christ name and tank God thru am.