1
Kolossians 2:6-7
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
So, just as una asept Jesus Christ as una Oga God, make una kontinue to live una life inside am. Make una dey strong for groun and dey grow inside Christ, so dat una faith go strong as wi dey tish una and una go dey tank God well-well.
Compare
Explore Kolossians 2:6-7
2
Kolossians 2:8
Make una take kare and nor let anybody fool una with wayo tok about human being wisdom and spiritual pawas wey dey rule di world, but make una dey do as Christ wont.
Explore Kolossians 2:8
3
Kolossians 2:13-14
Even doh una bin don die inside una sin bikos dem nor sekonsaiz una body, God kon make una dey alive with am, bikos E don forgive una sins. E don distroy doz bad-bad tins wey una dey do and wetin dem rite about awa debt wey fit kill us, God remove am kon nail dem for di cross.
Explore Kolossians 2:13-14
4
Kolossians 2:9-10
Bikos na Christ dey show us evritin about God. And una dey komplete inside am; bikos na-im bi di head for all di pawas wey dey for heaven and eart.
Explore Kolossians 2:9-10
5
Kolossians 2:16-17
So make una nor let anybody take food, drink, party, new moon or Sabat Day matter, take judge una. Bikos all dis tins na shadow for di tins wey go kom, but di really tin, na Christ!
Explore Kolossians 2:16-17
Home
Bible
Plans
Videos