YouVersion Logo
Search Icon

Kolossians 3

3
New Life
1So, if God raiz una with Christ, den make una put mind for tins wey dey heaven; di place where Christ for sidan for God rite side. 2Make una dey tink about tins for heaven, nor bi tins for dis eart, 3bikos una don die and una life dey save with Christ for inside God. 4Wen Christ (wey bi una life) go kom, una go follow am kom with glory.
5So make una kill evry bad karata wey dis world dey bring: Like to dey sleep with pesin wey una nor marry; dey bihave anyhow; follow dis world tins; dey do bad tins; long-trot and to serve juju. 6Na dis tins dey make God vex for doz wey nor dey obey am. 7Na so una dey live una life before wen una bi sinnas, 8but naw, to dey vex anyhow; to get bad mind for pesin; to take mout spoil pesin and to dey curse pipol, make una remove dem from una life. 9Since una don kill una old sef and di tins wey una dey do before, make una nor dey lie give each oda. 10Make una wear di new pesin, so dat una go dey new as una dey learn to know and bi like di Pesin wey kreate una.
11For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.
Love And Unity
12So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body. 13Make una dey bear with each oda; dey forgive each oda; even doh una get wahala with anybody. Just as Christ don forgive una, make una forgive odas too. 14With all dis good tins, make una love one anoda, bikos na love bi di best tin wey fit whole una togeda.
15Make Christ peace dey rule una heart (bikos na thru dis peace, Christ take koll una as one body) and make una dey tank God. 16Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart. 17For anytin wey una dey do, weda una dey tok or do oda tins, make una do am with awa Oga God Jesus Christ name and tank God thru am.
Prishin To Family
18Una wey bi wife, make una dey do wetin una husband wont, as Christ pipol suppose do.
19Una wey bi husband, make una love una wife and nor dey wiked to dem.
20Una wey bi pikin, make una dey obey una papa and mama for evritin, (dey do evritin wey una papa and mama tok), bikos na wetin Christ like bi dat.
21Una wey bi papa, make una nor do wetin go make una shidren vex, so dat life nor go taya dem.
22Una wey bi savants, make una obey una mastas (dey do wetin dem tok) for evritin and nor bi only wen dem dey look una. Make una nor dey do like pipol wey wont make dem praiz dem, but make una dey obey with betta mind, bikos una dey fear God. 23Anytin wey una dey do, make una do am with all una body, like sey una dey do am for Christ and nor bi for pipol, 24bikos una know sey na Christ una really dey serve and una know sey E go reward una. 25Pesin wey do bad, God go pay am back for wetin e do, bikos God dey judge evribody akordin to wetin dem do, since E nor dey support anybody anyhow.

Currently Selected:

Kolossians 3: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in