Judges 9

9
Abimelek Kill En Brodas
1Naw, Abimelek wey bi Gideon pikin, go Shekem town, where all en mama family dey stay kon tell dem 2make dem ask Shekem men sey, “Wetin make una wont make Gideon 70 shidren rule una, wen e bi sey only one man fit rule una? Make una remember sey, Abimelek na una own flesh and blood o-o.”
3So en mama family kon tok to di men and dem kon agri to follow Abimelek, bikos e bi dia own family pesin. 4Dem gi-am 70 pieces for silva from Baal temple and e use am take go hire wiked men wey nor dey obey di law. 5Den e go en papa house for Ofrah kon kill en step brodas, di 70 son wey Gideon born. E kill all of dem on-top one stone. But na only Jotam wey bi Gideon last born, run bikos e hide. 6All di leaders for Shekem and Bet-Millo kon make Abimelek king for di oak tree near di pila for Shekem.
Jotam Parabol
7Wen Jotam hear wetin happen, e go stand on-top Mount Gerizim kon shaut tell di pipol wey dey groun sey, “Shekem leaders, make una hear mi, so dat God go hear una! 8One day, all di tree gada togeda to choose king for demsef. Dem tell di olive tree sey, ‘Kom bi awa king!’
9“But di olive tree ansa, ‘I nor go fit stop to produce my oil wey dem dey use take dey honor gods and human being, just bikos I won bi king!’
10“Den all di tree tell di fig sey, ‘Make yu kom bi awa king.’
11“But di fig tree ansa, ‘I nor go fit stop to produce my good sweet fruit, just bikos I won bi una king.’
12“So dem tell di grape vine sey, ‘Make yu kom bi awa king.’
13“But di grape vine ansa, ‘I nor go fit stop to produce my wine wey dey make gods and human being happy, just bikos I won bi una king.’
14“Den all di tree kon tell shuku-shuku sey, ‘Make yu kom bi awa king.’
15“Di shuku-shuku ansa, ‘If una really wont make I bi una king, den make una kom stay under mi. If not, fire go from my shuku-shuku branches burn Lebanon cedars.’ ”
16Naw Jotam kon sey, “Wen una make Abimelek una king, una really dey honest and sincere? Una respet Gideon kon trit en family well since e deserve am? 17Make una remember sey, my papa fight and risk en life take save una from Midian pipol hand. 18But today, una don turn una back against my papa family. Una kill en 70 son on-top one stone. Abimelek na en pikin wey di savant woman born for am and na una family, so una kon make am king for Shekem. 19So, if wetin una do to Gideon and en family, dey good and honest, den make una happy with Abimelek and e go happy with una too. 20But if e nor dey good for una eye, make Abimelek burn Shekem and Bet-Millo men with fire. Den fire go kom out from Shekem and Bet-Millo kon burn and kill Abimelek too.” 21Bikos Jotam dey fear Abimelek en broda, e kon run go stay for Beer.
God Do Wetin Jotam Tok
22Abimelek rule Israel pipol for three years. 23Den God kon make Abimelek and Shekem men bigin fight demsef and dem kon go against am. 24Dis tin happen so dat, Abimelek and di men for Shekem wey enkourage am to kill Gideon 70 shidren, go sofa for wetin dem do. 25Shekem leaders hide some men for bush dey wait Abimelek and to rob anybody wey pass der. But Abimelek kon know about dia plan. 26So wen Gaal, Ebed pikin kom Shekem with en brodas, di men for Shekem kon put dia hope on am. 27All of dem go dia vineyard go pick grape kon make wine take do party. Dem go dia god temple dey drink, chop and curse Abimelek.
28So Gaal sey, “Who bi dis Abimelek wey wi Shekem men dey serve? Nor bi Gideon pikin e bi? Zebul dey take orda from am, but why wi go serve am sef? Make una serve Hamor shidren, wey bi Shekem papa. 29I wish sey, I dey lead dis pipol, I go kill Abimelek! I for tell am sey, ‘Make yu gada all yor soja kom out kon fight!’ ”
30Wen Zebul wey dey rule di town, hear wetin Gaal tok, e kon dey vex. 31E send messenjas go meet Abimelek for Arumah sey, “Gaal, Ebed pikin and en brodas kom Shekem and dem sey, dem nor go allow yu enter di town. 32So naw, make yu and yor men kom out for nite kon hide for di town bush. 33For morning, before sun kom out, make una attack di town, wen Gaal and en men kom out kon fight una, make una distroy dem finish!”
34So Abimelek and en men kom out for nite; divide demsef kon hide for di bush outside Shekem. 35Wen Abimelek and en men si sey, Gaal kom out kon stand for di town gate, dem stand up from where dem hide put.
36Gaal si dem, so e kon tell Zebul sey, “Look! Some men dey kom down from di mountin!”
Zebul ansa, “Nor bi human being dey kom! Na shadow yu dey si.”
37But Gaal tell am again, “Look! Some men dey kom from di mountin centre and one group dey kom from di tree where pipol wey dey si vishon dey stay!”
38Den Zebul tell am, “Nor bi yu sey, who bi Abimelek wey wi won serve? Dis nor bi di men wey yu curse? Go na! Make yu go fight dem!”
39So Gaal lead Shekem men go fight Abimelek. 40Gaal run and Abimelek kon porshu am. Many pipol wound go rish di town gate. 41Abimelek go back to Arumah and Zebul kon drive Gaal and en brodas komot for Shekem.
Abimelek Take-ova Shekem Town
42For di next day, Shekem pipol kon go di field and wen Abimelek hear am, 43e take en men, divide dem into three group kon hide for di bush around di field. Wen e si di pipol dey kom out from di town, en and en men kom out kon attack dem. 44Abimelek and en group, attack kon block di road wey dem dey pass enter di town. Den di remainin two group kon attack and kill di pipol wey dey for di field. 45Thru-out dat day, Abimelek fight for di town. E kill all di pipol for di town kon seize am. Den e skata di town kon pour salt full di groun.
46Wen all di leaders for Shekem Towa hear wetin happen, dem kon run go hide for El-Berit temple. 47Abimelek hear sey, all di leaders for Shekem Towa, gada for one place, 48so en and en men go on-top Mount Zalmon. E take axe for en hand kon kut one branch from one tree. E put am for en shoulder kon tell en men, “Make una kwik-kwik do wetin una si mi dey do!” 49So en men kut one-one branch kon follow am. Dem put di branches near di place where dem dey hide put kon lite fire der. All di pipol wey dey inside, die and dem bi like 1,000 men and wimen.
50Den Abimelek go Tebez and e kom surround and seize am. 51E get one strong towa for di town centre, so all di men, wimen and di leaders, run go der, lock di door kon go hide for di roof. 52Wen Abimelek kom attack di towa, e go di door won kon lite fire put, 53but one woman trow grindin stone from up kon land for en head and en brain kon krack.
54E kwik-kwik koll di pesin wey karry en weapon kon tell am, “Make yu kill mi with yor swod, so dat dem nor go sey, ‘Na woman kill mi.’ ” So di pesin use en swod take shuk am and e kon die. 55Wen Israel pipol si sey, Abimelek don die, dem kon go back to dia house.
56God pay Abimelek back for di bad tins wey e do to en papa, bikos e kill en 70 brodas. 57God still pay Shekem pipol back for di bad-bad tins wey dem do. And di curse wey Jotam, Jerub-Baal (wey bi Gideon) pikin curse dem, really follow dem.

ទើបបានជ្រើសរើសហើយ៖

Judges 9: pcm

គំនូស​ចំណាំ

ចែក​រំលែក

ចម្លង

None

ចង់ឱ្យគំនូសពណ៌ដែលបានរក្សាទុករបស់អ្នក មាននៅលើគ្រប់ឧបករណ៍ទាំងអស់មែនទេ? ចុះឈ្មោះប្រើ ឬចុះឈ្មោះចូល