Judges 10
10
Peace Kon Dey
1Afta Abimelek don die, one day, Tola wey dey stay Shamir for Efraim hill kountry, wey Puah bi en papa and na Dodo wey kom from Issakar tribe bi en grand-papa, kon save Israel pipol. 2E lead Israel pipol for 23 years before e die and dem beri am for Shamir. 3Afta am, Jair wey kom from Gilead kon lead Israel for 22 years. 4E get 30 sons wey dey ride 30 donkey and dem get 30 towns for Gilead, wey dem still dey koll Jair village. 5Jair die and dem beri am for Kamon. 6Israel pipol sin against God, bikos dem kon dey woship Baal, Ashtoret and Siria, Sidon, Moab, Ammon and Filistia pipol gods. Dem forget God kon stop to woship am.
Jeftah
7So, God kon dey vex for Israel pipol, den E make Ammon and Filistia pipol win dem. 8Dem opress and sofa Israel pipol wey dey stay Amor kountry, for Jordan River east wey dey Gilead, for 18 years. 9Ammon pipol cross Jordan River go fight Judah, Benjamin and Efraim tribe. And dis tin make Israel pipol weak well-well. 10Den Israel pipol kon kry give God sey, “Wi don sin against Yu. Wi leave Yu kon dey woship Baal juju.”
11So God ansa dem, “Wen Egypt, Amor, Ammon, Filistia, 12Sidon, Amalek and Maon pipol, opress una before and wen una kry give mi, I nor kom save una from dia hand? 13But una still leave mi kon dey woship oda gods, so I nor go save una again. 14Make una go kry give di gods wey una don choose, so dat dem go kom save una wen una dey trobol.”
15But Israel pipol tell God, “Wi don sin. So do us anytin wey Yu like, but today, wi dey beg sey make Yu kom save us.” 16So dem skata all dia yeye gods kon bigin woship God; den God kon sorry for Israel pipol, bikos of dia sofa.
17Ammon sojas kon ready to fight, so dem build dia kamp for Gilead. And Israel pipol gada kon kamp for Mizpa for Ramot. 18For der, Israel pipol and di leaders kon dey ask demsef, “Who won lead us go fight Ammon pipol? Di pesin wey go lead us, go bi awa leader for Gilead.”
ទើបបានជ្រើសរើសហើយ៖
Judges 10: pcm
គំនូសចំណាំ
ចែករំលែក
ចម្លង

ចង់ឱ្យគំនូសពណ៌ដែលបានរក្សាទុករបស់អ្នក មាននៅលើគ្រប់ឧបករណ៍ទាំងអស់មែនទេ? ចុះឈ្មោះប្រើ ឬចុះឈ្មោះចូល
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee