Judges 7

7
Gideon And Midian Pipol
1One day, Gideon and en men get up for early morning kon go stay near Harod where wota dey flow pass. Midian pipol kamp dey for di valley near di nort side wey divide dem from Moreh hill. 2God kon tell Gideon, “Di men wey yu get too many for mi to give una viktory ova Midian pipol. Dem go tink sey na dem win by demsef and bikos of dat, dem nor go kon tank mi. 3So make yu tell dem, ‘Anybody wey dey fear, make e go back to en house and wi go stay here for Mount Gilead.’ ” So 22,000 pipol kon go house back, but 10,000 pipol still remain.
4But God still tell Gideon, “Di men wey yu get still too many, make yu take dem go di wota and I go choose di ones wey I wont, for der. If I tell yu sey, ‘Make dis man follow yu,’ e go follow and if I sey, ‘Make dis man nor follow,’ e nor go follow yu.”
5So Gideon take di men go di wota, den God tell am, “Make yu take doz wey drink di wota like dog and nor bi doz wey go knee down drink am.” 6And na only three hundred men drink di wota like dog, but di rest knee down drink am.
7God tell Gideon, “I go use dis three hundred men wey drink di wota like dog, take save and give yu viktory ova Midian pipol. So, make yu tell di remainin pipol make dem dey go dia house back.” 8So Gideon send di men go dia house, escept di three hundred men wey follow di rules and na dem dey keep di trumpets. Midian pipol kamp dey under Israel pipol own for di valley.
God Tok With Gideon
9Dat nite, God tell Gideon, “Get up make yu go attack Midian pipol, bikos I don give yu viktory. 10But if yu dey fear to attack, make yu and yor savant Purah, go di kamp 11and una go hear wetin dem dey tok, den from der, yu go get di mind to attack.” So Gideon and en savant Purah kon go near dia enemy kamp. 12Midian and Amalek pipol and di men wey dey stay di desert, many for di valley like worm and dia kamel many like san-san for wotaside.
13Wen Gideon rish der, e hear one man dey tell en friend about di dream wey e dream kon sey, “I dream sey, bread wey nor get yist roll enter awa kamp kon nak and skata awa tents for groun.”
14So di friend ansa, “True-true, Gideon, Joash pikin wey kom from Israel, na en swod bi dat o-o! Na wetin di dream mean bi dat! God don gi-am viktory ova Midian pipol and all awa sojas.”
Gideon Distroy En Enemies
15Wen Gideon hear di dream and wetin e mean, e knee down kon woship God. Den e go back to en kamp kon sey, “Make una get up! Bikos God don give us viktory ova Midian sojas.” 16E divide en three hundred men into three groups kon give each pesin trumpet and cup wey tosh dey inside.
17E tell dem, “Wen wi rish di kamp korna, make una do anytin wey I do. 18And as mi and my group blow awa trumpet, make una blow una own round di kamp kon shaut, ‘Dis one na for God and for Gideon!’ ”
19As dem just shange doz wey dey guide before mid-nite, Gideon and en hundred men kom di kamp korna kon blow dia trumpet and break di cup wey dey dia hand, 20den di oda group, do di same tin too. All of dem hold dia tosh for dia left hand, while di trumpet dey dia rite hand and dem kon shaut, “One swod for God and for Gideon!” 21Each man stand for one place round di kamp and dia enemies sojas kon dey shaut run komot from di place wey dem dey.
22Wen Gideon men dey blow dia trumpet, God make di enemies bigin fight demsef with dia swod. So dem run go Zaretan, wey far rish Bet-Shittah and Abel-Meholah town, near Tabbat. 23Israel pipol from Naftali Asher and Manasseh tribes kom out kon porshu Midian pipol.
Gideon And Efraim Pipol
24Gideon send messenjas go all di hill kountry for Efraim sey, “Make una kom join mi fight Midian pipol and make una guide Jordan River and di small rivers go rish Bet-Barah, so dat Midian pipol nor go cross go der.” So Efraim men kon go guide di river. 25Dem katch two Midian shief wey bi, Oreb and Zeeb. Dem kill Oreb for Oreb rock and Zeeb for where dem for dey press wine and di place name na Zeeb. Israel pipol still porshu Midian pipol, but dem bring Oreb and Zeeb head kom give Gideon for Jordan River east.

ទើបបានជ្រើសរើសហើយ៖

Judges 7: pcm

គំនូស​ចំណាំ

ចែក​រំលែក

ចម្លង

None

ចង់ឱ្យគំនូសពណ៌ដែលបានរក្សាទុករបស់អ្នក មាននៅលើគ្រប់ឧបករណ៍ទាំងអស់មែនទេ? ចុះឈ្មោះប្រើ ឬចុះឈ្មោះចូល