Judges 6

6
Gideon
1Israel pipol sin against God again, so E allow Midian pipol rule dem for seven years. 2Midian pipol get pawa well-well and Israel pipol kon dey hide for rock and oda place wey dey save for di hills. 3Anytime wen Israel pipol plant, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert go kon attack dem. 4Dem go kamp for di land kon distroy all dia plants from di aria for sout go rish Gaza. Dem go karry all di animals and dem nor go leave anytin make Israel pipol chop. 5Dem go kom with dia kattle and tent wey tick like lokust. Dem go use dia kamel take skata di land 6and Israel pipol nor fit do dem anytin.
7Den, Israel pipol kon kry give God make E help dem. 8So God send one profet go meet dem with dis message: “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: ‘I take una komot Egypt for where una for bi slave. 9I save una from Egypt pipol and from all di pipol wey opress una. I porshu all una enemies kon give una dia land. 10Den I tell una sey, “Na mi bi una Oga and God. Una must nor woship Amor pipol gods; even doh una dey stay dia land naw.” But una nor gri listin to mi.’ ”
Gideon And God
11Den God angel kom Ofrah village kon sidan under di oak tree, wey bi Joash wey kom from Abiezer family, own. Den, en pikin Gideon dey hide pick wheat for one wine press, so dat Midian pipol nor go si am. 12Di angel appear to am kon sey, “Strong man, God dey with yu!”
13Gideon ansa, “My Oga! If God really dey with us, wetin make all dis tins dey happen to us? And where all di mirakle wey awa grand-grand papa dem tell us? Bikos dem sey, ‘Na God take us komot from Egypt!’ But naw, God don forget us kon allow Midian pipol dey rule us.” 14Den God angel turn kon tell am, “Make yu go with di pawa wey yu get kon save Israel pipol from Midian pipol, bikos na mi dey send yu!”
15Gideon ansa, “My Oga! Na how I go take save Israel pipol? Na my family weak pass for Manasseh tribe and na mi small pass for di family!” 16Den di angel tell am, “Yu go fit do am, bikos I go dey with yu and yu go distroy Midian pipol like sey yu dey fight one pesin.” 17Gideon sey, “If yu go really help mi, den make yu show mi sign, so dat I go know sey na di Oga God really dey tok to mi. 18Abeg, make yu nor komot until I bring food kon offa give yu.”
Di angel ansa, “I go stay here until yu kom.”
19Den Gideon rush go house go kook one yong goat den e use flower bake bread wey nor get yist. E put di meat for basket kon put di bread for pot, den e karry am go give di angel wey dey under di oak tree.
20Di angel tell am, “Make yu put di meat and di bread for dis rock, den pour di oil on-top.” So Gideon do as e tok. 21God angel tosh di meat and bread with di stik wey e hold and fire kom out from di rock kon burn di food finish. Den di angel disappear. 22Gideon bigin kry, wen e kon know sey na God angel bi dat, den e sey, “My Oga God wey get pawa, I don si yor angel face-to-face!”
23But God tell am, “Nor worry or fear, bikos yu nor go die.”
24So Gideon build one altar for der give God kon koll am, “Yahweh Shalom wey mean, ‘Na Oga God bi peace.’ ” Till today, di altar still dey for Ofrah wey bi Abiezer family land.
Gideon Distroy Di Altar
25Dat nite, God tell Gideon, “Make yu take yor papa melu and anoda seven years melu, den distroy and skata yor papa Baal altar and di Asherah juju wey dey near am. 26Den, yu go build betta altar for di Oga yor God on-top dis hill. Afta yu don build di altar, yu go take di sekond melu kon burn am as ofrin for di altar and yu go use di Asherah juju pole wey yu skata, take do firewood.”
27So Gideon take ten among en savant follow body go do wetin God tok. But e do am for nite, bikos e dey fear en family and di pipol for di town.
28Wen di pipol wake-up di next day, dem si sey dem don distroy di juju altar kon skata di Asherah juju wey dey near am. Dem kon si di sekond melu wey dem burn as ofrin on-top di new altar wey dem build for der.
29So dem ask demsef, “Na who do dis tin?” Afta dem don ask evribody, dem kon know sey na Gideon wey bi Joash pikin, do am.
30So di pipol tell Joash, “Make yu bring yor pikin kom out, bikos e must die for wetin e do so.”
31But Joash tell di pipol wey kom meet am, “Why una dey fight for di juju? Una dey defend am? Anybody wey won fight or defend di juju, dem go kill-am before morning! If Baal really bi god, den make e defend ensef kon distroy and kill di pesin wey skata en altar!” 32From dat time go, dem kon dey koll Gideon, “Jerub-Baal,” bikos Joash sey, “Make Baal defend ensef, bikos na en altar dem distroy.”
Gideon Gada Di Sojas
33Leta, Midian, Amalek pipol and anoda tribe for di desert gada togeda kon cross Jordan River go kamp for Jezrel Valley. 34Na wons God Spirit enter Gideon body, so e blow trumpet take koll all Abiezer family kom out make dem follow am. 35E send messenjas go Manasseh, Asher, Zebulun and Naftali sey make all dia sojas kom and dem kon follow am.
36Den Gideon tell God, “If Yu won really use mi take save Israel, just as Yu promise, 37den make Yu show mi with di sign wey I go ask for: Dis nite, I go put wool for where wi for dey pick wheat, but wen day break and I si sey dew wet di wool and di groun dey dry, den I go know sey Yu go help mi save Israel pipol, just as Yu promise.” 38And evritin happen as Gideon tok am. Wen Gideon wake-up for morning, e skwiz di wool and di wota wey kom out, full one bowl.
39Den Gideon tell God, “Abeg! Make Yu nor vex for mi sey I still won tok, bikos I still like do one test with di wool and dis time, I like make di wool dey dry, while di groun go soak with wota.”
40So dat nite, God do wetin Gideon ask for. Di next day, di wool dry well-well, but dew soak di groun.

ទើបបានជ្រើសរើសហើយ៖

Judges 6: pcm

គំនូស​ចំណាំ

ចែក​រំលែក

ចម្លង

None

ចង់ឱ្យគំនូសពណ៌ដែលបានរក្សាទុករបស់អ្នក មាននៅលើគ្រប់ឧបករណ៍ទាំងអស់មែនទេ? ចុះឈ្មោះប្រើ ឬចុះឈ្មោះចូល