Jeftah seize di place where dem dey pass cross Jordan River and if anybody from Efraim won try cross go back, Gilead men go shalenge and ask am, “Yu bi Efraim pesin?” If di pesin say, “No, I nor kom from der,” dem go tell am make e sey, “Shibbolet.” If e kom from Efraim, e go sey, “Sibbolet,” bikos Efraim pipol nor fit koll dat word well. Den dem go take am go kill for Jordan River korna. Na 42,000 Efraim pipol dem kill for dat time.