1
1 Korintians 15:58
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.
ប្រៀបធៀប
រុករក 1 Korintians 15:58
2
1 Korintians 15:57
So, make wi tank God wey give us viktory thru awa Oga God Jesus Christ.
រុករក 1 Korintians 15:57
3
1 Korintians 15:33
Make una nor let anybody deceive una, “Bad friends dey spoil good karata.”
រុករក 1 Korintians 15:33
4
1 Korintians 15:10
But God kind! I bi wetin I bi and God mesi for mi, nor bi yeye tin. I dey work pass any oda apostle; aldo na God grace dey help mi.
រុករក 1 Korintians 15:10
5
1 Korintians 15:55-56
“Yu deat! Where yor pawa? Yu deat! How yu go take shaut sey yu win?” Na sin dey make deat win and na di law dey kause sin.
រុករក 1 Korintians 15:55-56
6
1 Korintians 15:51-52
I won tell una one big sekret: Nor bi all of us go die, but all of us go shange. Before wi klose awa eye open am, e go don happen. As dem dey blow di last trumpet, all doz wey don die go raiz. All of us go shange, so dat wi nor go die again.
រុករក 1 Korintians 15:51-52
7
1 Korintians 15:21-22
Just as pipol go die bikos of Adam, na so too wi go raiz-up kom life, bikos of Christ. Adam bring deat kom meet all of us, but Christ bring life kom.
រុករក 1 Korintians 15:21-22
8
1 Korintians 15:53
Awa body wey don die and rotin go kon shange to body wey nor go ever die or rotin.
រុករក 1 Korintians 15:53
9
1 Korintians 15:25-26
Christ go rule until e don put all en enemies under en pawa and di last enemy wey e go distroy, na deat.
រុករក 1 Korintians 15:25-26
គេហ៍
ព្រះគម្ពីរ
គម្រោងអាន
វីដេអូ