Psalms 6
6
Prayer For Help
David Song
1My God, make Yu nor drive mi, bikos Yu dey vex.
Nor ponish mi with yor vexnashon.
2Make Yu sorry for mi, bikos I dey weak.
Make Yu heal mi, bikos my bones dey shake.
3I dey fear well-well.
Na how e go tey rish, before Yu go kon save mi?
4Make Yu kom back kon help mi.
Save mi bikos of yor love wey nor dey fail.
5Pesin wey don die, nor dey remember Yu.
Na who go fit praiz Yu from inside grave?
6I don taya to komplain,
bikos evry nite,
I dey wet my bed with wota from my eyes.
7Sofa don make my eyes blind.
My eyes dey weak, bikos of my enemies.
8All of una wey dey do bad tins,
make una leave mi alone,
bikos God don hear my kry.
9God don hear as I dey beg;
E go ansa my prayers.
10So make disgrace follow all my enemies
and make dem dey fear well-well!
Make dem run turn back,
go hide with shame.
Currently Selected:
Psalms 6: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee