Psalms 5
5
Prayer For Proteshon
For Di Kwayamasta: Di Song
1My Oga God, make Yu listin as I dey pray to Yu!
Make Yu listin to my komplain.
2My King and my God,
make Yu listin to my kry for help,
bikos na only Yu I dey pray to.
3Make Yu listin to my vois for morning, bikos evry morning,
I dey kom meet Yu and dey wait with patient make Yu ansa mi.
4My God, Yu nor dey like bad tins;
Yu nor fit bear wiked pipol sins.
5So, proud pipol nor go fit stand for yor present,
bikos Yu hate anybody wey dey do bad tin.
6Yu go distroy doz wey dey lie well-well.
God nor like doz wey dey kill and deceive pipol.
7Bikos of yor love wey nor dey die,
I go enter yor house
kon bow woship Yu for yor holy temple.
8My God, make Yu save mi as Yu dey lead mi,
bikos my enemies dey korna dey wait to katch mi.
Make Yu remove all di problem wey dey di road
wey Yu dey take mi pass,
9bikos my enemies nor dey tok di trut.
Wetin dey hongry dem to do, na to distroy odas;
dia troat bi like open grave
and na so-so lie-lie words full dia mout.
10My God, make Yu disgrace dem.
Make dia own trap katch dem.
Make Yu drive dem,
bikos of dia sins and bikos dem don turn against Yu.
11But make doz wey Yu dey guide, always dey happy!
Make dem always dey shaut for joy!
Guide dem, so dat doz wey loyal to Yu, go happy!
12My God, true-true, Yu dey reward doz wey dey fear Yu.
Yu dey always protet dem well-well,
bikos of yor favor wey nor dey end.
Currently Selected:
Psalms 5: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee