YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 37

37
Wetin Go Happen To Wiked And Good Pipol
David Song
1Make yu nor worry yorsef about wiked pipol
wey dey prosper or jealous doz wey dey do bad tins!
2Bikos dem go soon die like grass.
Just as flower dey die for dry sizin,
na so too dem go die trowey.
3Make yu trust God and do wetin dey good,
den yu go get peace for di land and yu go prosper.
4Make yu depend on God
and E go give yu evritin wey yu wont.
5Make yu kommit evritin wey yu dey do for God hand.
Trust am and E go help yu.
6E go show sey yu dey innocent
kon defend yu for publik.
7So, make yu wait for God with patient!
Make yu get mind as yu dey wait am!
Make yu nor worry about wiked pipol wey dey prosper or fear,
bikos of wetin dem get.
8Make yu nor dey vex, bikos na trobol,
vexnashon dey bring.
9God go distroy wiked pipol,
but na doz wey trust God, go inherit di land.
10Wiked pipol go soon vanish and wen una look for dem,
una nor go si dem again.
11Doz wey dey honbol,
go inherit di land and dem go get peace kon prosper.
12Wiked pipol dey plan against God pipol;
dem dey attack God pipol anyhow.
13But God just dey laf,
bikos E know sey di day to judge dem, don near well-well.
14Wiked pipol dey use dia swod and bow take kill poor pipol,
doz wey dem dey opress and doz wey dey raitious.
15But dia swod go stab dia own heart
and dia bows go break.
16So e dey good to fear God with di small money wey pesin get,
dan to do evil kon get money well-well.
17God go take wiked pipol pawa,
but E go protet doz wey dey fear am.
18God dey guide innocent pipol evriday
and dem go get propaty wey go last forever.
19E nor go leave dem wen tins hard and even wen honga dey,
dem go get enough food to chop.
20But wiked pipol go die,
bikos God enemies bi like flower for field
wey go soon vanish like smoke.
21Wen wiked pipol borrow sometin, dem nor dey pay back,
but doz wey dey fear God dey give tins to pipol with happiness.
22Na doz wey God bless go get di land,
but doz wey E curse, go die.
23God dey lead doz wey dey fear am.
E dey-dey happy with evritin wey koncern dia life.
24Even doh dem dey shake, dem nor go ever fall,
bikos God hold dem with en hand.
25Bikos since wen I dey yong kon rish naw wey I don old,
I neva si God leave doz wey dey fear am
or allow dia shidren go beg for food.
26Dis pipol dey always happy to give
and blessing dey follow dia shidren.
27So, make yu turn from bad tins kon do good
and yu go stay for di land forever.
28Bikos God like to dey judge well
and E nor go ever leave doz wey dey fear am.
29Doz wey dey fear God go inherit di land
and dem go stay der forever.
30Doz wey dey fear God dey advise pipol well
and dem dey tok wetin dey rite.
31Dem don make God law dia own,
so dem nor go ever sin.
32Wiked pipol dey set trap for God pipol,
dem dey find ways to take kill dem.
33But God nor go let wiked pipol win
or let dem kondemn doz wey dey fear am.
34So make yu put yor hope for Oga God.
Make yu dey always waka for en ways
and E go honor yu wen E give yu dis land,
den yu go si as E dey distroy wiked pipol.
35Pipol wey wiked and nor dey sorry for odas, I don si
as dem dey prosper like tree for betta groun,
36but wen I look again,
I si sey dem don die go!
Even doh I look evriwhere weda I go si dem,
I nor si dem again!
37So, make yu follow doz wey dey honest and dey do good,
bikos doz wey like peace go get betta future.
38God go distroy wiked pipol
and dem nor go si tumoro.
39But God go save doz wey dey fear am
and na-im go protet dem wen dem dey for trobol.
40God go help and save dem from wiked pipol.
E go save dem with en pawa and dem go dey save inside am.

Currently Selected:

Psalms 37: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in