YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 36

36
Wiked Pesin
David Song
1Wiked pipol nor get good heart
and dem nor dey fear God.
2Bikos dem blind,
dem nor fit si as dem really wiked rish.
3Evritin wey dem tok na lie and dem dey deceive pipol.
Dem nor dey ever gri do good tins.
4Instead of dem to dey sleep for nite, na bad tins dem dey plan.
Wetin dem dey do nor dey good.
Dem nor even dey try to turn from dia wiked ways.
5My God, yor love wey nor dey fail, big and wide like di heavens;
just as yor goodness high pass di kloud for sky.
6Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom.
Yu protet both pipol and animals.
7My God, si as I value yor love wey nor dey fail!
Evribody dey save under yor feada shadow.
8Yu dey feed dem from di plenty food wey Yu get for yor own house
kon let dem drink from yor wota wey dey give life,
9bikos na Yu bi di wota wey dey give life;
di lite wey make us dey si.
10Make Yu pour yor love wey nor dey fail on pipol wey love Yu;
make Yu judge well for pipol wey get klean heart.
11Nor let proud pipol opress mi
or allow wiked pipol drive mi komot from my house.
12Si! Wiked pipol don fall!
God don trow dem down and dem nor go get up again.

Currently Selected:

Psalms 36: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in