1
Psalms 37:4
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Make yu depend on God and E go give yu evritin wey yu wont.
Compare
Explore Psalms 37:4
2
Psalms 37:5
Make yu kommit evritin wey yu dey do for God hand. Trust am and E go help yu.
Explore Psalms 37:5
3
Psalms 37:7
So, make yu wait for God with patient! Make yu get mind as yu dey wait am! Make yu nor worry about wiked pipol wey dey prosper or fear, bikos of wetin dem get.
Explore Psalms 37:7
4
Psalms 37:3
Make yu trust God and do wetin dey good, den yu go get peace for di land and yu go prosper.
Explore Psalms 37:3
5
Psalms 37:23-24
God dey lead doz wey dey fear am. E dey-dey happy with evritin wey koncern dia life. Even doh dem dey shake, dem nor go ever fall, bikos God hold dem with en hand.
Explore Psalms 37:23-24
6
Psalms 37:6
E go show sey yu dey innocent kon defend yu for publik.
Explore Psalms 37:6
7
Psalms 37:8
Make yu nor dey vex, bikos na trobol, vexnashon dey bring.
Explore Psalms 37:8
8
Psalms 37:25
Bikos since wen I dey yong kon rish naw wey I don old, I neva si God leave doz wey dey fear am or allow dia shidren go beg for food.
Explore Psalms 37:25
9
Psalms 37:1
Make yu nor worry yorsef about wiked pipol wey dey prosper or jealous doz wey dey do bad tins!
Explore Psalms 37:1