Psalms 38
38
Prayer Wen Pesin Dey Sofa
David Prayer
1My God, make Yu nor porshu or ponish mi,
bikos Yu dey vex!
2Yor arrow don shuk mi.
E don wound mi well-well
3and bikos Yu dey vex,
my body nor dey strong again,
bikos of my sin.
4I dey die inside my own sin
and dis wahala too heavy for mi to karry.
5Bikos of my sins,
di sore for my body don start to smell.
6I nor fit stand strait again and wahala full my life.
Evriday, I dey kry and mourn waka.
7I dey shame well-well
and na so-so sick I dey sick.
8I don taya and my own don finish.
I dey kry from my heart, bikos of all di pain for my body.
9So, Oga God, I know sey Yu know wetin I wont.
Yu dey hear as I dey kry with pain.
10My heart dey beat fast-fast;
my pawa don finish and my eye don blind.
11Pipol wey I love and wey bi my friends,
dey run from mi, bikos dem dey fear my diziz.
Even my own family membas stand for far dey look mi.
12Yet, my enemies still dey set trap to kill mi.
Pipol wey hate mi dey plan to skata my life
and na evriday dem dey plan against mi.
13But I bi like who nor dey hear wetin dem dey tok.
I kwayet dey look dem like sey I nor sabi tok.
14Naw, I bi like deaf to dem.
I nor dey ready to kworel or ansa dem back.
15But I dey wait for Yu, my God.
My Oga God, make Yu kom ansa mi.
16I dey pray, “Make Yu nor let my enemies happy, bikos I fall for groun.”
17Na die I dey so o-o, bikos na so-so pain I dey face.
18But naw, I dey konfess my sins; I really dey sorry for evritin wey I don do.
19I get many wiked enemies and dem hate mi without any rizin.
20Dem dey pay mi bad for good kon dey oppoz mi for di good tins wey I do.
21So my God, make Yu nor leave mi.
Nor stand for far dey look mi.
22My God and Savior, make Yu kwik-kwik kom help mi.
Currently Selected:
Psalms 38: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee