YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 35

35
Prayer For Help
David Song
1My God, make Yu oppoz doz wey dey oppoz mi
and fight doz wey dey fight mi.
2Make Yu wear yor war klot,
ready for war, den kom save mi.
3Make Yu lift yor spear and javelin against pipol wey dey porshu mi,
den I go bilive wetin Yu tok sey,
“Na mi wey bi God, go diliver yu!”
4Make shame and disgrace follow pipol wey dey try to kill mi;
make Yu drive dem back and disgrace doz wey won wound mi.
5Make Yu blow dem trowey like leaf wey breeze blow
and make yor angels porshu dem.
6Make Yu make dia way dark and make groun draw dem fall,
as God angel dey porshu dem,
7bikos I nor do dem any bad tin,
but dem dey set trap and dig pit to katch mi.
8So make wahala kom meet dem at wons!
Make di trap wey dem set for mi, katch dem!
Make dem fall enter di pit wey dem dig for mi.
9Den I go happy, bikos of my God.
I go happy, bikos E save mi.
10I go praiz God with all di bones wey dey my body kon sey:
“Na who I wont take kompare with my Oga God?
Na who go fit save pipol wey nor strong from pipol wey strong?
Na who go fit protet pipol wey nor get help
and poor pipol from tif?”
11Wiked pipol dey lie for my head.
Dem dey akuiz mi about bad tins wey I nor do.
12Dem dey pay mi bad for di good wey I do
and dia wahala dey make mi sick.
13Wen dem dey sick, I dey sorry for dem.
I dey ponish mysef as I dey fast for dem.
If I dey lie, make God nor ansa my prayers!
14I dey mourn for dem, just as I go do for my broda or friend.
I dey bow with sorrow like sey I dey mourn for my mama.
15But wen I fall, dem go dey happy
kon gada demsef togeda dey dance.
Dem gada togeda to kause wahala for mi
and dem nor gri stop or taya.
16Dem dey laf and koll mi difren names;
while some dey try to bite mi.
17My God, na so Yu go just dey look dem?
Yu nor go do anytin?
Make Yu save mi from dis lions wey won kill mi!
18Den I go tank Yu for where yor pipol gada put.
I go praiz Yu for all yor pipol front.
19Make Yu nor let my enemies happy
sey dem win mi.
Make Yu nor let pipol wey hate mi, even doh I nor do anytin,
happy bikos I dey sofa.
20Dem nor dey tok about peace.
Dem dey plan against innocent pipol wey dey mind dia business.
21Dem go dey shaut, “Yes o-o! Yes o-o!
Wi don get am at last!”
22My God, Yu know all dis tins.
So, make Yu nor just keep kwayet, make Yu nor live mi naw.
23Make Yu raiz-up kom defend mi!
My Oga God, make Yu take my matter like yor own.
24Show sey I nor do anytin,
bikos na Yu dey judge well.
Make Yu nor let my enemies laf mi,
bikos of di trobol wey I dey face.
25Make Yu nor let dem sey, “Si, wi don get wetin wi wont!
Wi go chop am alive!”
26Make disgrace and shame follow pipol
wey dey happy sey I dey sofa.
Make nobody honor doz wey dey dance,
bikos I dey sofa and make shame kover dem.
27But make Yu give joy and happiness to pipol wey dey help mi.
Make dem always dey sey,
“God dey great and E wont make en savant dey save!”
28Den I go tok about yor korrect judgement
and I go praiz Yu forever.

Currently Selected:

Psalms 35: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in