YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 34

34
God Good
David Song Wen E Pritend Sey E Dey Kraze And Abimelek Kon Porshu Am
1I go always dey praiz God.
I go always dey tok about all di good tins wey E dey do.
2Na only God name I go take boast;
so make doz wey dem dey opress, listin and happy well-well.
3Kom make wi tok about how God great rish;
kom make wi praiz en name togeda.
4I pray to God and E ansa mi
kon free mi from all my fear.
5Doz wey dey go meet am make E help dem,
go happy well-well and shame nor go ever katch dem.
6I pray to God as I dey sofa and E ansa mi;
E save mi from evritin wey dey worry mi.
7Bikos na God angel dey guide mi,
na so too E dey protet and guide all di pipol wey dey fear am.
8Make yu kom try God, den yu go si sey God dey good:
Make yu si as God bless di pipol wey bilive am!
9Una wey bi God pipol, make una fear am,
bikos doz wey dey fear am go get evritin wey dem nid.
10Yong lions wey strong well-well still dey hongry,
but doz wey trust God go get all di good tins wey dey dis world.
11My shidren, make una kom listin to mi
and I go tish una how to fear God.
12E get anybody wey won live betta life?
Anybody like to get long life?
13Den make yu nor use yor mout take tok bad tin
and make yor lips nor dey lie!
14Make yu turn from wiked tins kon do wetin dey good.
Make yu dey leave for peace with evribody
and do evritin to keep am like dat.
15Pipol wey dey do wetin dey rite,
God eye nor dey komot from dia body
and en ear dey open to hear wen dem kry for help.
16But God dey trowey en face from doz wey dey do bad tins;
E dey remove dem from dis eart.
17God dey hear en pipol wen dem koll am for help.
E dey save dem from all dia wahala.
18Pipol wey nor get hope, God dey-dey near dem;
E dey save doz wey dia spirit dey die.
19Pipol wey dey do wetin dey rite, dey face trobol well-well,
but God go save dem from all dia wahala.
20God dey protet en pipol well-well
and E nor go let any bad tin happen to dem,
21but wiked pipol go must face wahala
and God go ponish doz wey hate en pipol.
22God go save pipol wey dey serve am
and E nor go kondemn anybody wey dey obey am.

Currently Selected:

Psalms 34: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in