YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 25

25
Prayer For Proteshon
David Song
1My God, na only Yu I dey depend on.
2Na only Yu I trust,
so make Yu nor let pipol disgrace mi
or allow my enemies happy wen I fall.
3Nobody wey trust Yu dey si disgrace,
but disgrace na for doz wey dey try to deceive odas.
4My God, make Yu show mi di rite way
kon point di road wey I go follow.
5Make Yu tish mi, so dat I go know di trut,
bikos na Yu bi di God wey save mi and evriday,
I dey put my hope for yor hand.
6My God, remember yor kindness and love wey nor dey fail,
wey Yu dey show us, since awa grand-grand papa time.
7Make Yu nor remember di sins wey I kommit wen I yong.
Remember mi for di lite wey yor love wey nor dey fail dey bring,
bikos Yu my God, dey sorry for pesin.
8God dey good and E dey do wetin dey rite;
E dey show di rite road to pipol wey dey waka lost.
9Doz wey dey honbol,
E dey help dem do wetin dey rite,
bikos E dey tish dem en ways.
10All doz wey dey keep God kommand and obey en laws,
E dey show dem en faithfulnes
kon lead dem with love wey nor dey fail.
11My God, bikos of di honor wey yor name get,
make Yu forgive mi my many-many sins.
12How wi go take know doz wey dey fear God?
Na doz wey God go show di rite road wey dem go follow.
13Dem go prosper
and dia shidren go inherit di land.
14God na friend to doz wey dey fear am
and E dey tish dem en kovenant.
15Na God I always dey look up to,
bikos na-im save mi from di trap wey my enemies set.
16Make Yu turn kon sorry for mi,
bikos na only mi dey and I dey sofa well-well.
17My problems dey worse evriday.
So, make Yu save mi from wahala!
18Make Yu feel my pains kon si my trobol,
den Yu go forgive mi all my sins.
19Si as my enemies many pass mi
and as dem hate mi rish!
20Make Yu protet mi!
Make Yu save my life from dem!
Nor let mi si shame, bikos na only Yu go fit save mi.
21As I dey loyal and honest rish,
Yu dey protet mi, bikos na Yu bi my hope.
22So my God,
make Yu save Israel pipol from all dia trobols.

Currently Selected:

Psalms 25: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

Video for Psalms 25