YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 24

24
Di Great King
David Song
1Na God get di eart and evritin wey dey inside.
Di world and evribody wey dey stay inside, na en own too.
2E build di eart foundashon on-top sea
kon make am stand on-top wota.
3Na who go fit klimb go God mountin?
Na who go fit stand for en Holy Place?
4Na only doz wey get klean hand and pure heart;
pipol wey nor dey serve juju or lie or do bad tins.
5Dem go get God blessing
kon bi di God wey dey save dem, friend.
6Dis kind pipol dey go find and woship am,
bikos na-im bi di Oga wey bi Jakob God.
7Naw, evry old gate, make una open!
Evry old door, make una open,
so dat di King wey get glory go enter inside.
8Who bi dis King wey get glory?
Na God wey dey strong and get pawa well-well;
God wey get pawa to fight war.
9Naw, evry old gate, make una open!
Evry old door, make una open,
so dat di King wey get glory go enter inside.
10Who bi dis King wey get glory?
Na di Oga God of all ogas;
Na-im bi di King wey get glory.

Currently Selected:

Psalms 24: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in