Psalms 26
26
Betta Pesin Prayer
David Song
1My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart,
so make Yu show sey I dey innocent.
2O my God, make Yu look mi well-well,
den test my heart,
so dat Yu go know wetin I dey tink.
3Bikos I dey sure about yor love wey nor dey fail
and I dey live my life,
just as Yu sey make I leave am.
4I nor get time to spend with lie-lie pipol
or waka with dem.
5I hate to dey where bad pipol dey
and I nor go ever follow wiked pipol waka.
6My God, I dey live my life well,
so dat I go fit kom yor altar
7kom tank and tell Yu
about all di wonderful tins wey Yu don do.
8Oga God, I love yor temple;
di place where Yu dey and where yor glory for dey shine.
9Make Yu nor let mi sofa with my enemies
and nor kill mi with wiked pipol.
10Dia hands dirty with di wiked tins wey dem don do
and dem dey always take bribe.
11But I nor bi like dat; I dey live betta life.
So, make Yu kom save and sorry for mi.
12Naw, I dey save and I don join di pipol wey dey woship Yu,
so I go praiz my God.
Currently Selected:
Psalms 26: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee