YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 22

22
Praiz God Inside Pain
For Di Kwayamasta: David Song
1My God, my God, wetin make Yu forget mi?
Wetin make Yu dey far from mi wen I dey kry for help?
2My God, na evriday I dey koll Yu, but Yu nor dey ansa.
Na evry nite Yu dey hear my vois, yet I still dey sofa.
3Yu dey holy
and na Yu get all di praiz for Israel.
4Awa grand-grand papa dem trust Yu
and Yu save dem.
5Dem kry give Yu and Yu diliver dem.
Dem trust Yu and Yu nor ever disgrace dem.
6But naw, I don turn worm instead of man.
Evribody hate and dey laf mi!
7Anybody wey si mi, dey laf mi.
Dem go look mi kon shake dia head sey,
8“Nor bi dis man trust God?
Make God save am naw!
If God love am well-well, make E kon diliver am naw!”
9Yet Yu allow my mama born mi well
and I trust Yu from small pikin.
10Dem born mi put for yor hand and na Yu dey kare for mi.
Na Yu bi my God from di time wen dem born mi kom rish naw.
11So, make Yu nor too stay far from mi,
bikos trobol dey near and no oda pesin fit help mi.
12My enemies gada round mi like strong melu and wiked animals from Bashan.
Dem gada won bite mi!
13Dem dey open dia mout against mi
like lion wey dey hongry.
14My life bi like wota wey dem trowey and all my bones don skata.
My heart bi like kandol wey dey melt inside mi.
15My strent don dry like mold wey sun beat.
My tongue don gum my mout.
Yu don trow mi for groun kon leave mi make I die for der.
16My enemies gada round mi like many dogs and bad-bad pipol dey kom katch mi.
Dem don shuk my hand and leg.
17Naw, I fit kount all my bones
and my enemies dey laf as dem dey look mi.
18Dem divide my klot among demsef.
Dem trow dice take divide my garment.
19My God, nor dey far from mi!
Na Yu bi my strent; make Yu kwik kom save mi!
20Make Yu save mi from di swod
kon guide my life from doz dogs.
21Take mi komot from di lion mout
and from di wiked melu horn.
22I go tok about yor name for where my kountry pipol dey.
I go praiz Yu for where yor pipol gada put.
23Evribody wey dey fear God, kom make wi praiz am!
All Jakob shidren-shidren, make una kom make wi honor am!
24Bikos E nor leave or forget poor pipol as dem dey sofa.
E neva turn en back to dem, but E dey listin to dia kry for help.
25I go praiz Yu for where yor pipol gada.
Doz wey dey woship Yu, na for dia present I go for do wetin I vow.
26Make doz wey dem dey opress,
si food kon chop beleful.
Evribody wey dey fine God, go praiz am
and dia heart go dey happy with joy wey nor dey end.
27Di whole eart go know God kon run go meet am.
Evribody for di world go bow woship am.
28Bikos na God bi di king wey get pawa
and E dey rules evry nashon.
29Make rish pipol for di world kom woship am.
Evribody must bow to am, plus doz wey don die
and doz wey nor fit save dia own life.
30Awa shidren sef go serve Yu.
Awa shidren-shidren go hear about di wonders wey God don do.
31Dem go tell doz wey dem neva born naw about all di good tins wey God dey do.
Dem go hear about evritin wey E don do.

Currently Selected:

Psalms 22: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in