Psalms 21
21
Prayer To Win
For Di Kwayamasta: David Song
1My God, si as di king dey rijoice, bikos of yor pawa!
E dey happy and shaut, bikos Yu make am win.
2Yu don gi-am evritin where e wont and na evritin wey e ask for,
Yu gi-am.
3Na suksess and progress Yu take welkom am back
kon put one fine gold crown for en head.
4Wen e sey make Yu save en life,
Yu do evritin wey e ask for and en family go rule forever.
5Yor viktory dey gi-am betta honor.
Viktory with majesty wey make evribody know am for evritin.
6Yor blessing bi like klot for en body
and Yu gi-am joy for yor present.
7Bikos di king trust God,
en love wey nor dey fail, nor go let di king fall.
8Di king go katch all en enemies.
E go seize evribody wey hate am with en strong rite hand.
9Wen Yu appear, Yu go trow dem put for fire wey dey burn well-well.
God go vex distroy dem for di fire.
10Yu go distroy dia shidren-shidren from dis world
and dem nor go ever get shidren again.
11Aldo dem plan against Yu,
dia wiked plan nor go work.
12Dem go turn and run from Yu,
bikos of yor arrow wey Yu shot.
13My God, make Yu raiz-up with all yor pawa
and wi go praiz and sing songs
to take celebrate evritin wey Yu don do.
Currently Selected:
Psalms 21: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee