Psalms 2
2
God Na King
1Wetin make pipol wey dey dis world dey vex? Wetin make dem dey make plans wey go fail?
2Di kings for di world gada with rulers kon dey plan against God and di king wey E choose.
3Dem dey sey, “Make wi break di shains wey dem take shain us! Make wi free awasef from dia trap!”
4But di King wey dey heaven dey laf dem anyhow.
Yes! God dey laf dem well-well.
5So God kon vex tok to dem and dem bigin fear wen E sey,
6“I don choose my king for Zion wey bi my holy hill.”
7Den di king sey, “I go tell una wetin God kommand.
God tell mi sey: ‘Yu bi my pikin! Today, I don bi yor papa!
8Make yu ask mi, and di pipol wey dey dis world, I go give dem to yu as yor propaty and evriwhere for di world, go bi yor own too.
9Na iron rod yu go take break dem kon skata dem like pot wey dem mold with san!’ ”
10So naw, una wey bi king, make una do wetin dey rite; una wey dey rule di world, make una dey take korreshon!
11Make fear dey una heart as una dey serve God! Make una turn from sin kon meet God as una dey fear am!
12Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave.
But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!
Currently Selected:
Psalms 2: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee