YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 1

1
God Blessing
1God go bless di pesin wey nor dey follow wiked pipol advise,
dey waka with sinnas or sidan with aproko pipol!
2Instead, e dey always dey happy to obey God kommand
and na both for day and nite,
e dey study dem.
3E bi like tree wey dem plant near wota;
wey dey bear fruit for di korrect time and en leaf nor dey dry.
E dey prosper for anytin wey e do.
4But nor bi so e bi for wiked pipol!
Instead, dem bi like leaf wey breeze blow trowey.
5Bikos of dis, wiked pipol nor go fit stand for Judgement Day
and sinnas nor go fit dey for where God pipol gada put.
6True-true, God dey guide en pipol for evritin wey dem dey do,
but E go distroy doz wey nor dey follow en ways.

Currently Selected:

Psalms 1: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in