YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 17

17
Innocent Man Prayer
David Prayer
1My Oga God, make Yu hear my kry for help, den judge my kase.
Listin to my prayer, bikos na trut I dey tok.
2Show sey I dey innocent,
bikos Yu dey si doz wey dey rite.
3Na nite wen I dey sleep Yu take test my mind kon shek my heart.
Yu don shek mi kon si sey I nor dey wrong.
I don sey I nor go sin with wetin I dey tok or do.
4I don follow yor kommand wey
nor let mi follow wiked and bad pipol.
5Na only yor ways I dey follow; I neva stop to follow Yu.
6My God, I dey pray to Yu, bikos I know sey Yu go ansa.
Abeg, make Yu listin to mi as I dey pray.
7Make Yu use yor wonders take show mi yor love wey nor dey fail.
Yu don save doz wey kom meet Yu for help.
Yu save dem from dia enemies with yor mighty pawa.
8Make Yu protet mi as pesin dey protet en own eye.
Make Yu hide mi under yor feada.
9Make Yu protet mi from wiked pipol wey dey attack mi;
from wiked enemies wey gada round mi,
10bikos dem nor dey sorry for pesin.
Make Yu hear as dem dey boast!
11Dem don gada round mi naw
dey wait to trow mi for groun.
12Dem bi like lion wey dey hongry and dem nor fit wait to tear mi to pieces.
Yes! Dem bi like yong lion wey hide for bush.
13My Oga God, make Yu raiz-up!
Make Yu stand against dem kon nak dem fall!
Make Yu use yor swod take save mi from wiked pipol!
14My God, with di pawa wey dey yor hand,
make Yu distroy pipol wey dey espect dia reward from dis world.
But doz wey Yu like well-well, make Yu give dem enough
and dia shidren go get plenty
kon die leave propaty for dia shidren-shidren.
15Bikos I dey raitious, I go si Yu.
Wen I don leave dis world kom meet Yu,
I go si Yu face-to-face and belle go sweet mi.

Currently Selected:

Psalms 17: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in