Psalms 18
18
David Viktory Song
David Song Wen God Save Am From Saul
1My God, I love Yu well-well
and na Yu bi my strent.
2Na God bi di rock wey dey protet mi.
Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi
and I dey save inside am.
3I koll God wey get all di praiz
and E save mi from my enemies.
4Deat dey round mi
and trobol won kill mi;
5na so-so grave I dey dream about and na to die,
dey hongry mi.
6But inside my trobol, I kry to God.
Yes! I pray to my God make E kom help mi
and E hear mi from en temple,
bikos my kry rish en ear.
7Fear kon make di pipol for di eart dey shake.
Di mountins foundashon kon dey shake too;
dem dey shake bikos God dey vex.
8Smoke dey kom out from dia nose;
fire dey pour kom out from dia mout with hot shako.
9So, God open di heavens
kon kom down and dark kloud dey under en leg.
10E sidan on-top angel feada kon fly go;
E fly go with strong breeze.
11E kon hide ensef for darkness
and na di strong dark kloud E take round ensef.
12Betta tick kloud kover di lite wey dey round am
and many stones and shako kon dey fall.
13God vois from heaven bi like tonda
and evribody dey hear as di Most High dey shaut.
14E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash,
dem kon dey konfuse more-more.
15Den as God kommand and as E just breath,
di sea bottom open and di eart foundashon kon dey show.
16E kom down from heaven kon save mi,
den E drag mi kom out from deep wota.
17E save mi from my enemies wey get pawa well-well;
from doz wey hate and too strong for mi.
18Dem attack mi wen I dey trobol,
but God support and help mi.
19E take mi go where dey save;
E save mi, bikos E love mi.
20God reward mi, bikos I do wetin dey rite;
E bring mi kom back, bikos I dey innocent and
21bikos I dey always keep en kommand.
I neva ever turn from my God kon follow evil.
22I dey follow all en rules
and I neva ever rijet en laws.
23For God present, I nor do any bad tin; I don keep mysef from sin.
24God reward mi, bikos I do wetin dey rite.
E don si sey I dey innocent.
25E dey show ensef sey E dey faithful to doz wey dey faithful
and to doz wey get respet,
Yu dey give dem respet.
26To pipol wey get pure heart,
Yu dey show dem as Yu pure rish,
but to wiked pipol, Yu nor dey sorry for dem at-all.
27Yu save gentol pipol,
but dey disgrace proud pipol.
28Yu lite one lamp for mi.
Na di Oga my God put lite for my darkness.
29With yor pawa, I fit kill many sojas.
With my God wey dey my side, I fit jump pass any wall.
30God ways dey pafet and all en promise na true.
E dey guide evribody wey kom make E protet am.
31Na who bi God escept God?
Na who again bi Solid Rock escept awa God?
32God make mi strong with en strent
and E make my way strait.
33E make my leg strong for groun like deer own
kon make mi fit stand on-top high mountins.
34E train my hand, so dat I go fit fight war
kon bend even di bow wey strong pass.
35My God, Yu don give mi wetin go protet mi.
Yor rite hand dey support mi and I don dey strong,
bikos of di way wey Yu dey help mi.
36Yu don make betta road for mi,
so dat I nor go draw fall.
37I porshu my enemies kon katch dem
and I nor stop until I distroy dem finish.
38I kill all of dem finish
and all of dem fall under my leg.
39Yu don give mi strent to fight war;
Yu don put my enemies under my leg.
40Yu put my leg for dia neck
and I don distroy evribody wey hate mi.
41Wen dem koll pipol to help dem, nobody gri kom.
Dem even kry to God, but E nor gri ansa dem.
42I grind dem till dem turn to dust
kon swip dem enter gutta like dirty.
43Yu make mi win doz wey dey akuiz mi.
Yu make mi rule oda nashons
and pipol wey I nor even know, dey serve mi.
44Wons dem hear about mi, dem dey obey.
Strenjas and dia kountry pipol dey listin to mi.
45Dem nor get strent again
and dem even dey fear for dia house.
46God dey alive!
So, make praiz bi my Rock own
and I go bless my God wey save mi!
47Na en bi di God wey dey ponish doz wey wound mi.
E put di nashons under mi
48kon save mi from my enemies.
E keep mi for where my enemies nor go for fit tosh mi
kon save mi from wiked pipol.
49Bikos of dis, I go praiz God among di nashons;
I go sing praiz to en name.
50Yu don give betta viktory to yor king;
Yu don show yor love wey nor dey fail to David wey Yu anoint
and to en shidren-shidren forever.
Currently Selected:
Psalms 18: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee