Psalms 16
16
Prayer To Get Strong Mind
David Prayer
1My God, make Yu protet mi,
bikos I don run kom meet Yu for help.
2I tell my Oga God,
“Na Yu bi my Masta! Evry good and betta tin wey I get,
na Yu give dem to mi.”
3Na doz wey dey fear God for dis land, I dey respet pass!
I dey happy to si and listin to dem.
4Pipol wey dey run follow oda gods,
dia trobol dey plenty evriday.
I nor go follow dem do dia blood sakrifice
or even koll dia god name.
5My God, na Yu dey make mi strong and prosper;
Yu don give mi betta future.
6Evritin dey work for my good!
True-true, E don bless mi well-well.
7So I go bless God wey dey guide mi;
even for nite, my heart dey happy to praiz am.
8I don make God nomba one for evritin wey I dey do
and bikos E dey for my rite side,
I nor go shake or fear anytin.
9No wonder happiness full my heart,
bikos I dey rest well and fear nor dey my life.
10Bikos God nor go leave my soul inside grave
or allow en holy pikin rotin for der.
11Yu don show mi di way wey dey give life
kon give mi joy for yor present
and I dey happy to stay with Yu forever.
Currently Selected:
Psalms 16: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee