My God, I dey pray to Yu, bikos I know sey Yu go ansa.
Abeg, make Yu listin to mi as I dey pray.
Make Yu use yor wonders take show mi yor love wey nor dey fail.
Yu don save doz wey kom meet Yu for help.
Yu save dem from dia enemies with yor mighty pawa.