YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 14

14
As Man Wiked Rish
For Di Kwayamasta: David Song
1Na only fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.”
Dem nor good at-all and dia ways bad well-well.
No one among dem dey do wetin good!
2God dey look evribody from heaven;
E dey look to si if anybody really get sense and dey find am.
3But e nor dey, bikos evribody don turn from am; evribody don spoil finish.
Nobody dey do good again.
Yes! E nor get anybody at-all.
4Doz wey dey do bad nor go ever learn?
Dem dey chop my pipol like bread and dem nor dey pray to God.
5So fear go katch dem,
bikos God dey with di pipol wey dey obey am.
6Even doh wiked pipol dey fight poor pipol,
God go guide and protet dem.
7E go from Zion kon save Israel pipol!
So wen God don save en pipol, Jakob shidren go shaut with joy
and Israel pipol go happy well-well.

Currently Selected:

Psalms 14: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in