Psalms 13
13
Prayer For Help
For Di Kwayamasta: David Song
1My God, Yu go forget mi forever?
Na how long Yu go trowey yor face from mi?
2How long I go dey struggol with pain inside my soul and get sorrow for my heart?
Na how long my enemies go always dey opress mi?
3My Oga God, make Yu turn kon ansa mi!
Make yu give mi strent again or I go die.
4Make Yu nor let my enemies dey make mout sey,
“Wi don win am!”
Den dem go dey happy sey I don fall.
5But I trust yor love wey nor dey fail.
I go happy, bikos Yu don save mi.
6Yes! I go sing to God,
bikos E don save mi.
Currently Selected:
Psalms 13: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee