Psalms 15
15
Wetin God Wont
David Song
1My God, na who go fit woship for yor temple?
Na who go enter yor present for yor holy hill?
2Na doz wey dey live good life and do wetin dey rite;
pipol wey dey tok trut with pure heart.
3Doz wey nor dey judge odas,
wound dia neighbours or tok bad about dia friends.
4Doz wey hate pipol wey dey sin and honor doz wey dey fear and follow God!
Pipol wey dey do wetin dem promise even wen e dey pain dem.
5Some pipol dey borrow money give odas without intrest and dem nor dey kollect bribe to lie for pesin head.
Di pipol wey dey do dis kind tins, go stand gidigba forever.
Currently Selected:
Psalms 15: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee