Psalms 12
12
Prayer for Help
David Song
1My God, make Yu diliver mi!
Bikos all doz wey dey fear and respet Yu,
wiked pipol don kill dem finish.
2Pipol dey lie give each oda;
dem just dey deceive demsef.
3Make God kut di tongue wey dey tok anyhow
kon distroy di mout wey dey boast!
4Dem dey sey, “Na di way wi dey tok,
dey make us prosper;
na wi get awa own lip:
who bi awa oga or who go fit stop us?”
5So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do
to pipol wey nor get help
and di pains wey poor pipol dey face,
I go do sometin; I go fight for dem,
bikos na so dem wont make I do since.”
6God promise dey pure well-well
like silva wey dem melt for fire.
7So Oga God, wi know sey Yu go protet doz wey dem dey opress.
Yu go guide dem forever from doz pipol wey sabi lie well-well,
8even from doz evil pipol wey dey evriwhere,
bikos wikedness don kover di whole land.
Currently Selected:
Psalms 12: pcm
Highlight
Share
Compare
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee