YouVersion Logo
Search Icon

Psalms 11

11
Hope For God
David Song
1I bilive and trust sey God go protet mi.
So wetin make yu dey sey,
“Fly like bird go hide for mountin,
so dat yu go dey save,
2bikos wiked pipol dey wound innocent pipol anyhow.
Dem hide for darkness
dey shot good pipol with dia bow and arrow.
3So, naw wey di foundashon don skata,
wetin good pipol go fit do?”
4But God dey for en holy temple;
E dey rule from heaven.
E dey look as evribody dey live dia life for dis eart.
5God dey si both good and bad pipol.
E hate doz wey love wahala.
6E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire
kon distroy dem with strong breeze.
7God dey good and E dey judge well;
so E go favor doz wey dey do good too.

Currently Selected:

Psalms 11: pcm

Highlight

Share

Compare

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in