YouVersion Logo
Search Icon

Matiu 14

14
How John Di Baptist Die
1Dat time, Herod wey dey rule hear about Jesus, 2so e kon tell en savants, “Dis na John di Baptist wey wake-up from deat! Naim make am get pawa to do all dis mirakle.”
3Before dis time, Herod don arrest John put for prison, bikos John dey akuiz am sey, 4“E marry Herodias wey bi en broda Filip wife.” 5Herod kon get mind to kill John, but e dey fear di pipol, bikos dem bilive sey, John na profet.
6So, for Herod birtday, Herodias dota dance well-well kon make Herod happy. 7Sotey Herod promise sey e go gi-am anytin wey e ask for. 8Just as en mama tell am, di girl kon sey, “Make yu give mi John di Baptist head for tray.” 9Di tin pain di king well-well, but as e don promise and bikos of di pipol wey kom di party, e kon kommand make dem go kill John. 10So e send en sojas go kut John head for inside prison. 11Dem bring di head for tray kon give di girl and e karry am go give en mama. 12Den, John disciples kon karry en body go beri and dem kon go tell Jesus wetin happen.
Jesus Feed 5,000 Pipol
13Wen Jesus hear wetin happen, e komot der enter boat kon go where pipol nor dey. But wen pipol from difren-difren town hear where e go, dem kon follow am. 14As e kom down from di boat, e si plenty pipol, so e sorry for dem kon heal all di pipol wey nor well among dem.
15Wen evening rish, en disciples kom meet am sey, “Dis place na wildaness and day don dey dark. Make yu send dis pipol go find food buy for demsef inside di village.”
16Jesus ansa, “Dem nor nid to go, make una find sometin give dem chop.”
17Dem kon tell am, “Na only five bread and two fish wi get for here.”
18Jesus ansa dem again, “Make una bring di bread and fish kom.” 19Den e tell di pipol make dem sidan for di grass. E take di five bread and two fish face heaven kon tank God. Afta e don tank God, e share di bread give en disciples make dem give di pipol. 20All of dem chop beleful and wen dem gada di food wey remain, e rish twelf basket. 21Di pipol wey chop na about 5,000 men, even doh dem nor kount wimen and shidren join.
Jesus Waka On-top Wota
22Afta Jesus don send di pipol go dia house, e kon tell en disciples make dem enter boat cross go di oda side. 23Afta di pipol don go, Jesus kon klimb go mountin go pray. E stay der go rish evening. 24By dis time, di boat don go far from land. Strong wave kom dey karry di boat up-and-down bikos heavy breeze dey blow.
25For early morning, Jesus kon dey waka go meet en disciples on-top di wota. 26Wen di disciples si am dey waka on-top wota, fear katch dem. Dem kon dey shake dey shaut, “Na ghost o-o!”
27But Jesus tell dem, “Make una heart strong! Na mi, make una nor fear.”
28Naim Pita ansa, “Oga God, if na yu true-true, koll mi make I kom meet yu for di wota.”
29So, Jesus tell am, “Make yu kom!”
Pita komot from di boat kon dey waka on-top di wota go meet Jesus. 30But wen e si as di breeze strong rish, fear katch am and e kon bigin sink. So e shaut, “Oga God, save mi o-o!”
31At wons, Jesus stresh en hand katch am kon tell am, “Yor faith too small. Why yu dey doubt mi?”
32Wen di two of dem don enter di boat, di breeze kon stop. 33Den di oda disciples for di boat kon bow down for Jesus front woship am sey, “True-true, yu bi God Pikin.”
34Wen dem don cross di river go di oda side, dem kon land for Gennesaret. 35Wen di pipol for der know sey na Jesus, dem send message go all dia village, den dem kon bring all di pipol wey nor well kom meet am, 36dey beg am sey, “Make di pipol wey nor well tosh yor dress” and all of dem wey tosh am, kon well.

Currently Selected:

Matiu 14: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in