Matiu 13
13
Parabol About Farmer
1Dat same day, Jesus komot from di house go sidan for Galilee wotaside. 2Many pipol gada round am, so e enter one boat and all di pipol sidan for groun near di wota. 3E kon use parabol tish dem many tins: “Si! E get one farmer wey go plant seed for en farm. 4As e dey plant, some seed fall for road and bird kon chop dem. 5Some fall for san wey get big-big stone. Di one wey fall for san, kwik grow bikos di san nor deep. 6So wen sun kom out, e burn dem and bikos dia rut nor deep well, dem kon die. 7Some seed fall for shuku-shuku. Dem grow kom out, but di shuku-shuku, shuk dem die. 8But some seed fall for betta groun. Dem grow well kon bear oda seeds, some bear rish hundred, some sixty and some thirty. 9Anybody wey get ear, make e hear!”
Wetin Di Parabol Mean
10Den di disciples kom meet Jesus ask am, “Why yu dey tok to dis pipol with parabol?”
11Jesus ansa dem, “God don make una know all di sekret tins about en kingdom, but dis pipol nor know. 12Pesin wey get sometin, dem go gi-am more and wetin e get go kon plenty. But pesin wey nor get anytin, even di small one wey e get, dem go take am from am. 13Naim make I dey tok with parabol sey:
“ ‘Dis pipol get eye, but dem nor dey si,
dem get ear, but dem nor dey hear or undastand.’
14Na dis tin make wetin Profet Isaya tok happen,
‘Una go listin well-well, but una nor go undastand.
Una go look well-well, but una nor go si anytin,
15Dis pipol nor go fit undastand; dem nor won hear anytin,
dem klose dia eyes make dem nor for fit si and hear with dia ear.
Dia mind don block,
so dem nor go fit undastand,
but if to sey dem fit turn kom meet mi,
I for heal dem.’
16But God go bless una eye, bikos dem dey si well and una ear, bikos dem dey hear word. 17I tell una true word, many profets and good-good pipol don wait taya make dem for hear and si wetin una dey si, but dem nor si or hear am.
18“So, make una undastand wetin di farmer parabol mean: 19‘Wen pesin hear God word and e nor undastand am, di devil go kom tif di word wey dem plant for en heart, dis na di seed wey fall for road. 20Di seed wey fall for san wey get big-big stone, na pesin wey hear God word kon receive am with joy, 21but di seed nor get rut, bikos di word wey e hear, nor strong for en heart, so wen trobol kom, e nor go fit bear-am. 22Di seed wey fall for shuku-shuku, na pesin wey hear God word, but wahala, long-trot and to kwik get money for dis world kon shuk di word die for en heart and e nor kon bear fruit. 23But di seed wey fall for betta groun, na pesin wey hear and undastand God word. E kom bear fruit wey rish hundred, sixty and thirty.’ ”
Parabol About Grass
24Jesus kon tell en disciples anoda parabol, “God Kingdom bi like wen pesin plant good seed for en land. 25But for nite wen evribody dey sleep, di enemy kon go plant grass join dem. 26Wen di seeds grow kon dey bear fruit, di grass grow too.
27“So di savants tell dia oga sey, ‘Nor bi good seed wi plant for yor farm? Na where di grass from kom?’
28“Di oga ansa, ‘Na enemy plant dem.’
“So en savants sey, ‘Yu wont make wi go rut dem komot?’
29“But di oga tell dem, ‘No, if una go rut di grass komot, una fit make mistake rut some for di good seeds too. 30Make di good seeds and di grass grow togeda until harvest. Dat time, I go tell di pipol wey dey harvest sey, “Make una first rut all di grass, tie and burn dem, den gada di good seeds put inside my store.” ’ ”
Mustard Seed Parabol
31Jesus kon tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like mustard seed wey one man plant for en farm. 32Na di seed small pass but wen e grow, na di plant big pass oda plants for di farm and difren-difren birds kon build dia house for en branches.”
Parabol About Di Yist
33Jesus still tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like yist wey one woman take bake bread. E mix am with plenty flower and di small yist kon make di bread raiz well-well.”
Why Jesus Use Parabol
34Jesus tok all dis tins for parabol to di pipol. Evritin wey e tell dem, na parabol e use. 35E do am so dat wetin di profet tok, go happen:
“I go open my mout tok parabol,
I go tok evritin wey bi sekret since God kreate dis world.”
Jesus Esplain Di Parabol
36Den Jesus kon leave di pipol enter inside house. En disciples kon tell am, “Tell us wetin di grass parabol for farm mean.”
37Jesus ansa dem, “Pesin wey plant good seed na God Pikin; 38di farm na di world and di good seed na di kingdom pipol. Di grass na devil shidren 39and di enemy wey plant dem, na di devil. Di harvest na di last days and di harvest workers, na di angels for heaven.
40“Just as dem gada di grass burn dem for fire, na so e go bi for di last day. 41God Pikin go send en angels make dem go remove evritin inside en Kingdom wey dey make pipol sin and break God law. 42Dem go trow dem inside fire wey nor dey kwensh, where dem go kry and grind dia tit. 43Den, God pipol go shine like sun inside dia Papa Kingdom. Anybody wey get ear, make e hear!
Parabol About God Kingdom
44“God Kingdom bi like gold wey dem beri for field. One pesin wey si am, kon hide am. With happiness, e go sell evritin wey e get buy di land.
45“Again, God Kingdom bi like trada wey dey look for betta gold to buy. 46Wen e si one gold wey dear well-well, e kon go sell evritin wey e get buy am. 47Again, God Kingdom bi like net for sea wey katch difren-difren fish. 48Wen di net full, dem drag am komot from di wota kon sidan bigin put di good fish inside difren kontaina and trowey all di bad one. 49Na so e go bi for di day wen di world go end. Angels go kom separate evil pipol from di good ones 50and dem go trow evil pipol inside hell-fire, where dem go kry and grind dia tit.”
51Jesus ask dem, “Una undastand all dis tins?”
Dem kon ansa, “Yes.”
52Den Jesus kom tell dem, “Anybody wey dey tisha di law and e bi disciple for God Kingdom, go bi like pesin wey get house kon bring new and old tins kom out from inside di house.”
Dem Rijet Jesus For Nazaret
53Wen Jesus tok di parabol finish, e kon komot for der. 54Den e rish en village kon bigin tish di pipol for dia sinagog. Dem sopraiz well-well kon sey, “Where dis man from get dis kind sense and pawa wey e take dey do mirakle sef?” 55“Nor bi di karpenter pikin bi dis? Nor bi Mary bi en mama? James, Josef, Simon and Judas, nor bi dia broda e bi? 56Nor bi all en sistas dey stay here with us so? Na from where e for get all dis pawa?” 57So dem kon dey vex for am.
But Jesus tell dem, “Profet dey get respet for evriwhere, escept for en own village and among en family.”
58So Jesus nor do many mirakle for der, bikos dem nor bilive am.
Currently Selected:
Matiu 13: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee