1
Matiu 14:30-31
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
But wen e si as di breeze strong rish, fear katch am and e kon bigin sink. So e shaut, “Oga God, save mi o-o!” At wons, Jesus stresh en hand katch am kon tell am, “Yor faith too small. Why yu dey doubt mi?”
Compare
Explore Matiu 14:30-31
2
Matiu 14:30
But wen e si as di breeze strong rish, fear katch am and e kon bigin sink. So e shaut, “Oga God, save mi o-o!”
Explore Matiu 14:30
3
Matiu 14:27
But Jesus tell dem, “Make una heart strong! Na mi, make una nor fear.”
Explore Matiu 14:27
4
Matiu 14:28-29
Naim Pita ansa, “Oga God, if na yu true-true, koll mi make I kom meet yu for di wota.” So, Jesus tell am, “Make yu kom!” Pita komot from di boat kon dey waka on-top di wota go meet Jesus.
Explore Matiu 14:28-29
5
Matiu 14:33
Den di oda disciples for di boat kon bow down for Jesus front woship am sey, “True-true, yu bi God Pikin.”
Explore Matiu 14:33
6
Matiu 14:16-17
Jesus ansa, “Dem nor nid to go, make una find sometin give dem chop.” Dem kon tell am, “Na only five bread and two fish wi get for here.”
Explore Matiu 14:16-17
7
Matiu 14:18-19
Jesus ansa dem again, “Make una bring di bread and fish kom.” Den e tell di pipol make dem sidan for di grass. E take di five bread and two fish face heaven kon tank God. Afta e don tank God, e share di bread give en disciples make dem give di pipol.
Explore Matiu 14:18-19
8
Matiu 14:20
All of dem chop beleful and wen dem gada di food wey remain, e rish twelf basket.
Explore Matiu 14:20
Home
Bible
Plans
Videos