YouVersion Logo
Search Icon

Matiu 15

15
Human being Tradishon
1Some Farisee pipol and law tishas kom meet Jesus for Jerusalem ask am, 2“Why yor disciples nor dey obey awa eldas tradishon? Dem nor dey wosh dia hand before dem chop.”
3Jesus ansa dem, “Why una nor dey obey God kommandment, na bikos una won keep una tradishon? 4God sey, ‘Respet yor papa and mama, anybody wey curse en papa or mama, dem must kill-am.’ 5But una sey, ‘If anybody tell en papa or mama, “Wetin I won give yu before, I don gi-am to God”, 6den e nor nid to respet en papa again.’ Bikos of una tradishon, una don make God word yeye. 7Una wey dey pritend! True-true, na una Profet Isaya tok about wen e sey,
8“ ‘Dis pipol dey praiz mi with dia mout,
but dia heart dey far from mi
9and di woship wey dem dey give mi,
dey yuzles, bikos dem dey tish tradishon wey human being get.’ ”
Wetin Dey Make Heart Dirty
10Den Jesus gada di pipol kon dey tish dem, “Make una listin so dat una go undastand. 11Nor bi wetin pesin chop dey make am dirty, but na wetin e tok from en mout.”
12Den di disciples kon meet am sey, “Yu know sey Farisee pipol dey vex, bikos of wetin yu tok?”
13Jesus ansa, “Any plant wey my Papa for heaven nor plant, dem go rut am trowey. 14Make una leave dem! Dem bi blind pipol wey dey show blind pipol road. If pesin wey blind dey show anoda blind pesin road, two of dem go fall inside gutta.”
15But Pita tell Jesus, “Tell us wetin yu mean.”
16Jesus ansa, “Afta evritin wey I don tok so, una nor still undastand? 17Una nor know sey anytin wey pesin chop enter belle, e go shit am kom out? 18But di tins wey dey kom out from pesin mout, dey kom from en heart and na dis tins dey make di pesin dirty. 19Na from pesin heart bad-bad tins dey kom out and na dis tins dey make dem kill; sleep with who dem nor marry; tif; lie and judge pesin for en back. 20Na all dis tins dey make pesin dirty, nor bi bikos pesin chop with en hand wey e nor wosh.”
Kanaan Woman Faith
21Jesus komot der kon go Tyre and Sidon aria. 22For der, one Kanaan woman kry kom meet am sey, “Oga God, David Pikin, make yu sorry for mi! My dota nor well, bikos demon dey trobol am!”
23But Jesus nor tok. So en disciples kon beg am, “Drive dis woman komot for here, bikos e dey disturb us.”
24Jesus kon tell di woman, “Na di sheep wey lost among Israel pipol, naim God send mi kom find.”
25Di woman knee down for en front kon dey beg am sey, “Oga God, make yu help mi!”
26Jesus tell am, “E nor good to give dog di bread wey shidren suppose to chop.”
27Den di woman ansa, “Yes Oga God. But di dog demsef dey chop di small-small bread wey dey fall from dia oga tabol.”
28So Jesus tell am, “Madam, yor faith big well-well! Make wetin yu dey find rish yor hand.” Dat same time, di pikin kon well.
Jesus Heal Many Pipol
29Jesus komot from der go Galilee wotaside. Den e klimb one mountin go sidan. 30Many pipol karry pipol wey nor fit waka, blind, paralaiz, dumb and odas wey get difren sickness kom en front and e heal all of dem. 31Di pipol kon sopraiz well-well wen dem si who nor fit tok, dey tok, who nor fit waka, dey waka, who blind before, dey si naw and all of dem kon praiz Israel pipol God.
Jesus Feed For Tazon Pipol
32Jesus koll en disciples kon tell dem, “I dey sorry for dis pipol bikos dem don dey here with mi for three days and dem nor get anytin to chop. I nor wont make dem go back with honga, so dat dem nor go faint for road.”
33Di disciples ansa, “As dis pipol plenty so, where wi go fit get food wey go rish dem chop for dis wildaness?”
34Jesus ask dem, “How many bread una get?”
Dem ansa, “Na seven bread and some small-small fish.”
35So, Jesus tell di pipol make dem sidan for groun, 36kon take di seven bread and di fish. Afta e don tank God, e divide di bread and fish give en disciples make dem share am for di pipol. 37Di pipol chop beleful and di food wey remain, full seven basket. 38Di men wey chop na 4,000, even doh dem nor kount wimen and shidren join dem. 39Afta Jesus don send di pipol go dia house, e kon enter boat go Magadan aria.

Currently Selected:

Matiu 15: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in