Filippians 3
3
To No Christ
1Finally, my brodas and sistas, make una happy bikos una get Christ. I dey rite di same tin give una again, bikos e go help una.
2Make una shine una eye, bikos of doz wey dey bihave like dogs and wiked pipol wey dey ponish dia body! 3Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do. 4Aldo my own rizin important too. If anybody tink sey e get betta rizin to put hope for wetin human being dey do, mi Paul, get pass dem. 5Dem sekonsaiz mi eight days afta dem born mi. I kom from Israel, Benjamin tribe and I bi Hibru man. I bin dey live akordin to di law, bikos I bi Farisee. 6Bikos I really won do God work, I kon dey kause sirious wahala for di pipol wey dey di church. I do evritin just as di law sey make wi do, so dat wi go dey good for God eye. So, I nor get any fault. 7But all dis tins wey I si as gain, I kon kount dem to bi nor-tin bikos of Christ. 8Nor bi only doz ones, but naw, I dey look evritin as nor-tin, wen I kompare am with Christ, my Oga God wey I know and I trowey evritin, bikos of am. True-true, I dey look all doz tins as yeye, so dat I go fit gain Christ, 9kon bi one with am. My raitiousness nor kom from di law, but I dey raitious thru my faith for Christ. Bikos na thru faith God take make us dey raitious with am. 10Wetin I wont na to know am and di pawa wey wake Christ from deat; to sofa wetin e sofa; to bi as e bi wen e die, 11so dat mi too go still wake-up from deat, as e wake.
Kontinue To Go Front
12Nor bi sey I don get evritin wey I wont or God don make mi pafet, but I dey try make I get di prize wey dey kom from God kon hold am as Jesus Christ whole mi. 13My brodas and sistas, I nor look mysef like sey I don get evritin wey I wont. Bikos I dey tink of only one tin wey bi: To forget di tins wey don pass kon dey porshu di ones wey dey front 14and as I put my mind for dis tins, I dey try to get di prize wey bi life for heaven; prize wey make God koll us thru en pikin, Jesus Christ. 15So wi wey don mature for Christ, make wi get dis kind mind. But if una dey tink difren tins, I bilive sey God go show una di trut. 16So, make wi kontinue to follow di rules wey wi dey follow.
17My brodas and sistas, make una dey live like mi and dey learn from odas wey dey follow us as ezample. 18Bikos I don tell una before and I dey tok am again with tears for my eye sey, di way many pipol dey bihave, dey show sey dem bi enemies to Christ cross. 19Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about. 20But wi bilong to heaven and wi dey wait awa Savior wey kom from der, wey bi Oga God Jesus Christ. 21E go use en pawa wey make am Oga God for evritin, take shange dis awa ordinary body and awa body go kon bi like en own wey get glory.
Currently Selected:
Filippians 3: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee