1
Filippians 4:6
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.
Compare
Explore Filippians 4:6
2
Filippians 4:7
Den God peace wey pass wetin human being fit undastand, go guide una heart and mind, inside Christ.
Explore Filippians 4:7
3
Filippians 4:8
Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about.
Explore Filippians 4:8
4
Filippians 4:13
I fit do evritin thru Christ wey dey give mi pawa.
Explore Filippians 4:13
5
Filippians 4:4
Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!
Explore Filippians 4:4
6
Filippians 4:19
My God go give una evritin wey una nid, bikos of en glory and propaty wey dey inside Jesus Christ.
Explore Filippians 4:19
7
Filippians 4:9
So anytin wey una learn, hear and si mi dey do, make una dey do dem too. And di God wey dey give us peace, go dey with una.
Explore Filippians 4:9
8
Filippians 4:5
Make evribody know sey una nor like wahala, bikos Jesus go soon kom.
Explore Filippians 4:5
9
Filippians 4:12
E get sometaim wey I nor get and sometaim, I dey get plenty. But for evry kondishon, I don learn how to dey okay, weda my belle full or I dey hongry; weda I get plenty or I nor get anytin at-all.
Explore Filippians 4:12
10
Filippians 4:11
I nor dey tok dis one bikos I nid anytin, but na bikos I don learn to dey okay for any kondishon wey I si mysef.
Explore Filippians 4:11
Home
Bible
Plans
Videos