1
Joshua 6:2
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
God kon tell Joshua, “Si, I won distroy Jeriko for una, plus di king and en sojas.
Compare
Explore Joshua 6:2
2
Joshua 6:5
Wen una hear di trumpet sound, make di sojas shaut for war and di town wall go fall rish groun, den una go attack am.”
Explore Joshua 6:5
3
Joshua 6:3
Make una sojas mash round di town ones and make una do like dat for six days.
Explore Joshua 6:3
4
Joshua 6:4
Make yu tell seven priests make dem karry seven ram horn for di box front, den for di sevent day, make una mash round di town seven times, while di priests go dey blow di trumpet.
Explore Joshua 6:4
5
Joshua 6:1
Naw, dem lock and dey guide Jeriko gate, so dat Israel pipol don go fit attack am. Dem nor gri make anybody enter inside or go outside.
Explore Joshua 6:1
6
Joshua 6:16
Wen di sevent time rish, di priests kon blow di ram horn and Joshua kon tell di sojas, “Make una shaut for war, bikos God go give dis town to una!
Explore Joshua 6:16
7
Joshua 6:17
Di town plus evritin wey dey inside go bi God own, escept Rahab wey bi ashawo and evribody wey dey with am for inside en house, bikos e hide awa pipol wey go spy di town.
Explore Joshua 6:17