1
Joshua 5:15
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
Di oga among God sojas for heaven kon tell Joshua, “Make yu pul yor sandals, bikos di place wey yu stand put so, dey holy.” So Joshua do as di man kommand am.
Compare
Explore Joshua 5:15
2
Joshua 5:14
Di man ansa, “Na mi bi di oga among God sojas for heaven. Naw I don kom!” Joshua fall face groun kon sey, “Wetin my oga won tell en savant?”
Explore Joshua 5:14
3
Joshua 5:13
Wen Joshua don near Jeriko, e look up kon si one man stand for en front and di man hold swod for hand. Joshua waka go meet am kon ask, “Yu dey with us, abi yu dey against us?”
Explore Joshua 5:13