Joshua tell Israel pipol, “Wen una shidren-shidren ask sey, ‘Wetin dis stones mean?’ Make una tell dem, ‘Na wen Israel pipol cross Jordan River for dry groun.’ Di Oga una God dry Jordan River for una and una waka pass, just as E dry di Red Sea make wi waka pass.