YouVersion Logo
Search Icon

Joshua 4

4
Dem Karry Stone From Di River
1Wen dem don cross finish, God kon tell Joshua, 2“Selet twelf men from di pipol, one from each tribe. 3Den yu go tell dem sey, ‘Make una pick twelf stones from Jordan River centre, di very place where di priests stand put.’ Den, dem go karry di stones follow yu and yu go put am for di place where una go stay dis nite.”
4Joshua koll di twelf men wey e choose from each tribe 5kon tell dem, “Make una go for di Oga una God box front wey dey Jordan River centre. Each of una go put one stone for shoulder akordin to di tribes for Israel. 6Di stones go make una dey remember dis tin wey happen and wen una shidren-shidren ask sey, ‘Wetin make dis stones dey important to una?’ 7den make una tell dem how Jordan River take stop to rush, bikos of God Kovenant Box. Wen di box cross Jordan River, di wota stop to rush. Dis stones go make Israel pipol dey always remember wetin happen.”
8So, Israel pipol do wetin Joshua tell dem. Dem pick twelf stones from di river centre, akordin to di tribes for Israel, just as God kommand Joshua. Dem karry dem go di kamp kon put am for der. 9For di river centre where di priests wey karry di Kovenant Box stand put, Joshua kon put twelf stones for der. Di stones still dey der still today.
10Naw, di priests wey karry di Kovenant Box stand for Jordan River centre until di pipol do evritin wey God kommand, just as Moses tell Joshua. Di pipol cross kwik-kwik 11and wen di pipol don cross finish, di Kovenant Box and di priest kon cross too. 12Na Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe first cross, bikos na dem go first attack for war, just as Moses kommand. 13E rish 40,000 strong sojas wey mash dey go fight for Jeriko field and God dey with dem.
14Dat day, God give Joshua honor for Israel pipol front. Dem respet am till e die, just as dem bin respet Moses.
15God kon tell Joshua, 16“Make yu tell di priests wey karry di Kovenant Box make dem komot from Jordan River.”
17So Joshua tell di priests, “Make una kom out from Jordan!”
18Di priests wey karry di Kovenant Box kon komot from di river centre and as dem just enter dry land, di wota for Jordan kon start to rush well-well again.
19Di pipol cross Jordan River for di tent day for di first mont kon stay for Gilgal wey dey di east side for Jeriko borda. 20Di twelf stones wey Joshua take from Jordan River, e arrange dem for one place for Gilgal. 21Joshua tell Israel pipol, “Wen una shidren-shidren ask sey, ‘Wetin dis stones mean?’ 22Make una tell dem, ‘Na wen Israel pipol cross Jordan River for dry groun.’ 23Di Oga una God dry Jordan River for una and una waka pass, just as E dry di Red Sea make wi waka pass. 24E do am make all di kountry for eart know sey na God get all di pawa, so una must always obey di Oga wey bi una God.”

Currently Selected:

Joshua 4: pcm

Highlight

Copy

Compare

Share

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in