Na Christ make some among us bi apostles, profets, evangelist, pastors and tishas. Christ do like dis to prepare us for di ministry work, wey go make God church grow, so dat wi go bi one for di tins wey wi bilive and wey go make us really know God Pikin. Den, wi go dey tink like Christ.